Friday 29 June 2012

Beans Things

Since dem say Boko Haram dey poison Beans, Zubulu come get half bag 4house, he tell dem to prepare beans porridge.
As de food don, e tell dem to first give Bingo im dog so if him kick bucket waka, im go knw how far. After 30mins. bingo d dog still dey play around, so e begin whack im portion. Just as e take d last spoon, naim im gate man run enter house shouting "oga oga bingo don die". Na so zubu rush go swallow water, crude oil and even bleach to hold de beans hostage for belle, gate man run back again saying "the man wey jam bingo wit car wan say sorry" kai! O zubu abi buzu!!!

No comments:

Post a Comment