Tuesday 15 May 2012

Akpo's Story

One day my papa call me, my brother and my mother together and tell us say if we dream say them wan give us something for dream make we no collect, say na enemies wan give us bad things.

He say if we dream that kind dream make we tell am and he go buy that thing wey them wan give us for dream for us. Two days later my brother sleep for night dey mention RICE! RICE!! RICE!!!, ma papa wake am say wetin dey happen, he say them wan give am rice for dream. My papa give am #500 say make he take eat rice. When i see say the thing dey work... The next day i start to dey shout MR BIGGS!!! for night. Ma papa say wetin, i say them wan gimme Mr Biggs for dream. My papa gimme #1000 make i take eat Mr Biggs. Na so i do wey i take buy my phone.
But the one wey i do wey i take spoil evrything na for one night wen i dey shout RANGE ROVER SPORT!!!, ma papa wake up say wetin... I say them wan gimme RANGE ROVER SPORT for dream.
My papa say 'sleep make you collect am.

No comments:

Post a Comment