Friday 15 June 2012

Tamuno Goes to write Jamb Exam

Tamuno go write Jamb, when time for english reach, e begin spy one fine babe wey siddon near am.
She just dey shade dey go, she no even look up. She dey No. 79, im dey No. 62. He just thank God say He don butter im bread. Na im he begin shade follow the gurl, quick quick. As dem reach No.95, na im d gurl look up see am, she hala "WHAT IS IT? WHY IS YOU COPYING ME?" Na I'm he begin shout "WHO GET ERASER GIVE ME OH!!!!

No comments:

Post a Comment