Friday 14 September 2012

You no Sabi

Emeka: U be fool, u no sabi nothing.
Anofia: Ahhh...haba guy
Emeka: Na so. I fit prove am sef. If na night and u see 2 light for road, na wetin be dat?
Anofia: Na moto.

Emeka: Ehenh, but wish kind? Benz? Peugeot? or Lexus?
Anofia: I no know dat 1 oh
Emeka: U see am. Anyway, second proof. Na night, u see 1 light for road. Na wetin be dat?
Anofia: Na okada
Emake: Ehenh, wish one? Suzuki? Yamaha? or Kawas aki?
Anofia: Ahh....how I suppose know?
Emeka: U see am? I don show u say u be fool.
Anofia: Na wa 4 u o. Dis ur question sef. Oya make I axe u. If na night u see woman for roadside....miniskirt, big breast, red lips, big nyash, na wetin?
Emeka: Na ashawo
Anofia: Ehenh, but which one? Ur mama, ur sister or ur daughter? And that's how the fight started

No comments:

Post a Comment