Monday 25 June 2012

Whatever He says

I get one friend before wey im mouth b like prophet own, anything the guy yarn dey come true.
I just build my house that year, invite people for house warming naim my guy put for facebook, twitter and blackberry "Every place dat d sole of my foot will tread upon I will have". Naim I put security for my gate say make dem no allow am enter my house. U wan claim my house abi.

No comments:

Post a Comment